3
Peace Ofrin
1 “ ‘Wen pesin won give en animal as peace ofrin, e fit bi man or woman own, but di animal must dey okay. 2 Di man go put en hand for di animal head kon kill-am for di door-mot for di tent where dem for dey do meetin. Den Aaron sons wey bi priests, go rub di blood for di altar four side 3 kon give all dis parts for di animal to God as food ofrin: all di fat wey dey inside di animal intestine; 4 di kidney, di fat wey dey di kidney and di part for di liver wey good well-well. 5 Di priest go burn all of dem for di altar with di burnt ofrin. God like dis food ofrin smell well-well.
Animal For Peace Ofrin
6 “ ‘Dem fit use sheep or goat take do peace ofrin, weda na man or woman, but e must dey okay. 7 If una give sheep as ofrin, una must gi-am for God present. 8 Una go put una hand for di animal head kon kill-am for where dem for dey do meetin for di tent door-mot. Di priest go rub di blood for di altar four side 9 kon give all dis part to God as food ofrin: di fat, all di fat tail wey dem kut komot from near di backbone; all di fat wey kover di animal intestine; 10 di kidney and di fat wey dey di kidney; plus di part for di liver wey good well-well. 11 Di priest go burn dem for di altar as food ofrin to God.
12 “ ‘If una give goat as una ofrin, una must bring am kom God present, 13 put una hand for di animal head kon kill-am for di tent front. Di priest go rub di blood for di altar four side 14 kon give all dis part to God as food ofrin: all di fat wey dey di intestine, 15 di two kidney with dia fat and di part for di liver wey good well-well. 16 Den di priest go burn dem for di altar as food ofrin to God and God like am well-well. All di fat na God own.
17 “ ‘Make una nor ever chop any fat or blood and Israel pipol must obey dis law from one generashon go rish anoda.’ ”