113
Praiz God For En Goodness
1 Make una praiz God!
Una wey bi God savants, make una praiz am!
2 Make praiz bi God name naw
and forever!
3 Pipol go praiz God name
from east go rish west.
4 Dem dey praiz am ova all di nashons
and en glory high pass di sky for heaven.
5 Na who wi go take kompare di Oga awa God
wey sidan for di high throne?
6 E dey bend look
di sky and di eart.
7 E dey take poor pipol komot from dirty
kon remove doz wey nid help from where yeye tins dey,
8 so dat E go put dem for where prince dey-dey
and dem go dey with en pipol wey bi prince.
9 Woman wey nor get pikin,
E dey gi-am shidren kon make am dey happy.
So, make wi praiz God!