7
Haman Die
1 So di king and Haman kon go chop with Kween Estha 2 for di sekond time. As dem dey drink wine, di king kon ask Estha, “My kween, na wetin yu wont make I do for yu? Make yu tell mi and I go do am for yu. I go even give yu half of my kingdom.”
3 Estha ansa, “Abeg! My king, if yu go agri with wetin I wont, den make yu nor allow dem kill mi and my pipol.” 4 Bikos dem don sey make dem distroy, both mi and my pipol! If to sey dem just sell us as slaves, I nor for tell yu about am, but dem go soon kill all of us finish.
5 Den King Zazes ask Kween Estha, “Na who won kill una? Where di pesin dey?”
6 Estha ansa, “Na dis Haman bi di pesin wey won kill all of us!”
Den Haman kon dey fear as e dey look di king and kween. 7 Di king vex kon stand up go di gardin, den Haman kon go knee down for di kween front dey beg am, bikos e know sey di king go ponish am.
8 As Haman still knee down near Estha dey beg am, di king kon waka enter from di gardin.
As di king si am, e kon sey, “So yu even won rape my wife, di kween for my present?”
As di king still dey tok, dem kon kover Haman face. 9 Den one of di king savant wey dem dey koll Harbona kon sey, “Na true, Haman even dig one pit for en house where e won hang Mordekai put and na dis Mordekai save my king life. Di pit deep rish seventy-five fit!”
Di king kon sey, “Make una go hang Haman put for di pit wey e dig!” 10 So dem kon hang Haman for di pit wey e dig for Mordekai. Den di king kon stop to vex.