20
1,000 Years
1 Den I si one angel dey kom down from heaven, e whole di pit key and one big shain. 2 E seize di dragon, dat old snake wey bi Satan di devil and dem don tie am der for like 1,000 years. 3 Den di angel trow am put for di pit kon lock di door with key, so dat e nor go fit deceive pipol until di 1,000 years don komplete. (Afta dis tins, dem must free am for short time.)
4 Den I si thrones and pipol wey God don give authority to judge, sidan on-top di thrones. Doz wey dem kut dia head komot bikos of di trut about Christ and God word, I still si dem too. Dis ones nor woship di beast or en image and dem nor gri make dem put en mark for dia fore head or hand. Dis pipol raiz-up kom life kon rule with Christ for 1,000 years. 5 (But di rest pipol wey don die nor go live again, until di 1,000 years don komplete.) Dis na di first resureshon. 6 God don bless di holy pipol wey join for di first resureshon! And dis pipol nor go die again, but dem go bi God and Christ priests and dem go rule with am for 1,000 years.
Dem Win Satan
7 Wen di 1,000 years don finish, God go free Satan from en prison 8 and e go-go deceive pipol for di world; e go bring Gog and Magog togeda kon fight di war and dem go many like san-san for sea. 9 Dem go waka round di world and where God pipol dey stay and di town wey evribody love, fire go kom down from heaven kon burn am finish. 10 Den, dem go trow di devil wey deceive pipol inside God fire. Den di beast and en fake profets go sofa both day and nite forever and ever.
Di White Big Throne
11 Den I si one big white throne and di Pesin wey sidan put. Eart and heaven run komot from en present and dem nor si where to hide put. 12 And I si di pipol wey don die, both big and small, as dem stand for di throne front. Dem open plenty books and den kon open anoda book wey bi di Life Book. And dem judge doz wey don die akordin to wetin dem rite for di books sey dem do. 13 And doz wey don die inside sea kon kom out. Deat and grave release di ones wey dey inside dem and God judge dem akordin to wetin dem do. 14 Den dem trow deat and grave inside di fire. Dis fire na di sekond deat. 15 Anybody wey dem nor si en name inside di Life Book, dem go trowey am inside di big fire.