123
Prayer For Mesi
David Song
1 My God wey dey heaven,
na Yu I dey depend on.
2 Just as savants dey depend on dia masta
and as savant girls dey depend on dia madam,
na so wi too dey depend on di Oga awa God, until E go favor us.
3 My Oga God, make Yu sorry and pity for us,
bikos wi too don get awa own share for di trobol.
4 Di wahala wey wi get,
don taya us and awa trobol, plenty well-well.